🎧 Listen Live The Beat 99.9 FM

Live on air

China reopen borders afta three years, lift some Covid restriction

News

January 9, 2023

China don reopen im borders to international visitors for di first time since e impose travel restrictions for March 2020.

Incoming travellers no go need quarantine again and dis one mark one significant change for di kontri Covid policy as e dey battle increase in cases.

Meanwhile, dem go still require proof of negative PCR test wey di traveller must take within 48 hours of travelling.

Many pipo wey dey eager to reunite wit dia family don welcome di move.

For Hong Kong, 400,000 pipo dey expected to travel into mainland China in di coming weeks wit long queues for flights into cities wey include including Beijing and Xiamen.

One woman tell news agency Reuters she neva seen her parents in years – even as one of dem dey suffer from colon cancer – and say she dey “so, so happy”.